Sunday, March 27, 2011

CHRONICLES OF THE PALM WINE SHOP. EPISODE ONE: OGA JEGA-JEGA


Bros long time, wetin b ya name that year?
You don forget me, even after the last time, anyway my name na Jega-Jaga
I hear say na you be the main the main for dis election; wetin b your plan
The plan na to run the thing anyhow
Kai, that one no good o, Naija pipo don try na
Awa pipo no complain, we like to suffer and smile
But no be you collect 99 billion for the matter?
Madam forget that thing, men don chop clean mouth tè-tè
Haba, that one no good o, you for suffry pity poor man sha
Leave poor man, na God go helep am, e go better

Oya bros, make we talk beta now
See me see trouble o, na okpata I dey follow you talk since?
How dis election wan be?
Na we-we o
Ah, Oga Jega-Jaga, which wan be we-we again, abi na piss?
(Laughs) Na Business as usual madam
You sef, abeg explain quick quick, my husband go soon come from work
Dis election wey we dey so; People go Destroy People, People go Deceive People
Chei, Chineke! Again! No be you talk say dis one no go resemble before?
Madam, I tire for the matter. My hand dey padlock

Oya Bros, drink small palm wine, make we tuk well well
Madam, make you no vex me o, no be tuk we dey since or na the oda tuk u want?
Oga Jega-Jaga, I wan use God take beg you, make you helep our people, we don suffer reach
Madam, which kain pami you carry give me, my eye don dirty
Oga Jega Jega, na only one cup you drink, you still be man so, abi you don weak
Follow me enter room make we see if I weak true true
Tufia! (Smiles) This man sef. But I first tell you say my husband go soon come back now
Oya madam, wen we go shake bodi. The last time we too hurry. This time I get your time
Oga Jega –Jaga na this kain thin you dey like, oya come back tomorrow
(Smiles) Madam Josphine…

To be continued…

NB: The characters used in this piece are  fictional and semblance to real persons is entirely coincidenal

©2011 Ewoigbokhan Otaigbe Itua

No comments:

Post a Comment

Please leave your comments here. They should be related to the material posted. You can also leave suggestions on how you think i can improve the blog. Thank you!